pidgin english
My people, how una dey? I welcome all our brodas and sistas dem wey come from different place for Africa…some come from west Africa…others na from central Africa and different different places…. I welcome una all….
We don bring una this ogbonge program wey be sey we dedicate am to all our broda and sista dem wey comot from africa dey for here… dis program na for people wey hear pidgin de way wey i de tok am so…. and I know sey una plenty for this Novara Province well well…
Anywhere wey you dey, where be sey you fit hear the powerful signal from SMS radio where de full name na SIMPLY MUSIC and SHOW, make you ready to de hear us becos we go dey bring una correct story of how una fit stay for Italy wey una no go get any wahala…especially, if you de for the province of Novara and Palermo…
As una know sey dis wahala of Covid19 never comot from town…. make I remind una to de wear una face mask every time oooo… e go better to de change am from time to time… If you wear the one wey dem call clinical mask, dat one na to wear am once and throway am oooo…. but if you de wear de one wey dem carry cloth sow, make you wear am once and wash am wit soap every time ooo…
Make e no tay too much before una dey wash una hand ooo…
As we go de tok to una, we go de give una de necessary informate of how and wetin Italy need make una do…We go give una advice wey go help una join body with people for de area where una dey… if na school you wan go, advise dey for free professional and Italian courses wey you fit attend… those kind courses dey for many schools for the provinces where una dey.
For all dat kind advice and many others, na SMS radio go be your best friend ooo.
For people wey comot from Nigeria, make we let una know sey we dey yan 24/7 with Nigerian Embassy and Nigerian Immigration Office wey dey for Rome…
We go give una story of Banks, Hospitals, Post Office, Police, Cooperative and anything wey go better una lives for Italy here especially if you dey province of Novara and Palermo…
We go happy to hear from una on top any question or wahala wey una get… and after una reach us; we go try bring una all the answers for this ogbonge show wey go bring una all de story about migrants…
So una fit reach us for this phone number wey I want give una so:…de number na 351-064-5944.
Make una follow us for all social media platforms make we dey yan together. Make una de listen to SMS Radio always make una for fit get solutions to issues wey go make una life better…..
My people, una well done ooooo.G
lingua italiana
Benvenuti a tutti i nostri fratelli del centrafrica. Questa trasmissione è dedicata in particolare a tutti i migranti che capiscono la lingua pidgin e immagino siano moltissimi nella nostra provincia novarese.
Ovunque voi siate e raggiungibili dalle onde elettromagnetiche di SMS Radio… Simply Music and Show, ma anche via web www.smsradio.net. Cercheremo di darvi le notizie più importanti per una vostra migliore permanenza in Italia, in particolare nelle provincie di Novara e Palermo.
Dal momento che stiamo vivendo ancora in condizioni di pandemia covid-19 vi ricordo di indossare l mascherina cambiandole di volta in volta e di lavarvi spesso le mani.
Vi daremo inoltre informazioni riguardanti gli adempimenti che avete nei confronti dello Stato italiano, i consigli su cosa fare per avere un migliore rapporto con la società che vi circonda, consigli per la vostra scolarizzazione e i corsi professionali e di italiano gratuiti presso le scuole delle provincie in cui arriva questa trasmissione. Ascolterete interventi in esclusiva per rispondere alle vostre domande dall’Ambasciata Nigeria di Roma ma non solo, vi daremo notizie riguardanti le banche, gli ospedali, gli uffici postali, le cooperative, la Polizia di Stato insomma tutto ciò che potrà esservi utile per vivere in Italia e in particolare nelle due provincie: Novara e Palermo.
Cercheremo di leggere i messaggi che ci manderete con l’intento di trovare risposte da suggerirvi.
Tutto questo durante le puntate di News for Migrants.
Dunque mi raccomando, seguiteci e dite a tutti i vostri connazionali di sintonizzarsi su SMS radio per ricevere solo quelle notizie che… cerchiamo e trasmettiamo solo per voi e nella vostra lingua.
Alla prossima dunque …
English translation
Welcome to all our brothers from Central Africa. This program is dedicated in particular to all migrants who understand the Pidgin language and I imagine they are very many in our Novara province.
Wherever you are and reachable by the electromagnetic waves of SMS Radio … Simply Music and Show, but also via the web www.smsradio.net. We will try to give you the most important news, first of all for a better stay in Italy, in particular in the province of Novara and in that of Palermo.
Since we are still living in conditions of the covid-19 pandemic I remind you to wear the masks and change them from time to time. Also, wash your hands often.
In these episodes we will give you information regarding the obligations you have towards the Italian State, advice on what to do to have a better relationship with the society around you, advice for your schooling and free professional and Italian courses at the schools of the provinces where this broadcast arrives. SMS will stay close to you. We will bring you the voice directly and exclusively from the Nigerian Embassy in Rome to answer your requests. We will also give you news regarding banks, hospitals, post offices, cooperatives, the State Police, in short, everything that can be useful for living in Italy and in particular in the province of Novara and Palermo.
It will also be interesting to have your messages where you ask us for information that you are unable to obtain otherwise. We will try to find the best solutions by giving you the answers during the episodes of News for Migrants.
So please, follow us and tell all your compatriots to tune in to SMS radio to receive only those news that … we seek and transmit for you.